Who you help?
Tell that man wey sitdown for
there,who u help? Ask that man wey dey form chairman for there,who u help?
Chairman wey no fit buy me can coke,who u help?
You iron your agbada on Friday
dey spread like say na wings,who u help? You iron ur suit straight dey speak
many many English,who u help? In the words of rick ross “how many people u
bless,that’s how u measure success”
Election come,you dey ginger for votes meanwhile since
when u dey there,who u help? U enta lecture hall dey hala for students like say
u swallow trumpet meanwhile ur second name na carry-over,who u help?u come
campaign dey spread money dey give ur fellow party thugs to rig election for u
when the average masses no be party members,who u help?
Na only election time u dey remember say people fit chop
rice and when u dey share am dem go fight belle full before dem collect,who u
help? U sitdown for president seat dey give your fellow ijaw militants
contracts up and down,who u help?
Dem give u new office U say make people help u clean
am,who u help? When u dey buy,u buy for me? When u dey pop champagne,u pop for
me? U get Chairman U still dey trek,guy! go do Yahoo.when I see u,u want make I
dey hail like cow,loyalty don dey turn job dey loyal till u get hunchback.
U dey school dey form Boss meanwhile ur mama and papa dey
stay thatch house for sabo gari*SmH* who u help? Na to dey abuse people rights
wit ur big belle,who u help?
No comments:
Post a Comment