Story of my
friends
True life
story
E get 5
gods wey like to dey chill together; Jaguda (the guy like to dey do
everything), Ture (the guy too like shayo), Kpoko (the guy dey burn anything),
Doctor (the guy na walking chemist) and Shoko (the guy too like wahala and
woman).
Na so dem
chop finish one day, Jaguda come cut eye for Ture and Kpoko say make dem go
Jerry side go dey alright, Shoko sight dem come form busy body say him must
follow. Dem ginger say na change dem wan go collect, him say him must follow.
Na so dem
enta Jerry corner dey feel alright while Shoko dey look like Muchi-Muchi! Ture
come ginger am say if him take 1 swagga, him go bless am. Shoko like the mugu
wey him be come fall based on say mugu must fall, him no know say na setup.
Na so dem
start to dey feed am Bullet and him dey hala MORE! Before dem know, Shoko don
dey Swagga. Sharp Sharp dem carry BaBa put for head dey go back Heaven, for
Heaven gate BaBa collapse na him Jaguda carry am like BaBy go put for Throne.
Medina!
Medina!! Na him BaBa dey shout.Sharp Sharp,Everybody Ball out. As dem show
back,na hearsay dem hearsay devil and him demons come kidnap Shoko!...
To
be continued…
Dorti
Alexis Tosan
No comments:
Post a Comment