Sunday, 3 May 2015

Story of my friends part.2

True Life Story Part 2
A snitch among the gods
            Snitch! Snitch!! Snitch!!!..., was the name ringing in the head of the gods? Rat been done dey the house and nobody been soji, the food dey short and the gist dey leak. Na 1 rat dey inform the demons since…BAD BELLE!! IT’S ALLOWED, IT’S ALLOWED, IT’S ALLOWED.
            Shoko don pieces, dey rest jeje when F.K carry some otes! enta Zanga. Demon Waz show, dey ask dem make dem identify themselves dem dey jonze. Before dem soji demself, heaven gate don lock and Devil and him agents don dey stroll enta.
            Meanwhile F.K don peel out free dem, Jaguda dey waka him own jeje na him F.K block am con clear am the matter. Jaguda based on who him be con run reach the gate of Heaven only to meet am locked…Wahala don set! Na so gbege start, as Devil and him agents show, na so Zeus’ thunderbholt, Hades’ pitchfork and Poseidon’s trident land for BaBa body.
Based on say na person God must use, one of Devil agent still ginger on Jaguda behalf before Jaguda fit comot from the zone. Only for BaBa to reach outside, sight SNITCH dey hide for Ikoro! e ba bo! Na the rat be that!!, Jaguda don catch am!
Meanwhile, Shoko and the otes don package enta Hell.
To be continued…

Dorti Alexis TosanHe

Story of my friends

Story of my friends
True life story
            E get 5 gods wey like to dey chill together; Jaguda (the guy like to dey do everything), Ture (the guy too like shayo), Kpoko (the guy dey burn anything), Doctor (the guy na walking chemist) and Shoko (the guy too like wahala and woman).
            Na so dem chop finish one day, Jaguda come cut eye for Ture and Kpoko say make dem go Jerry side go dey alright, Shoko sight dem come form busy body say him must follow. Dem ginger say na change dem wan go collect, him say him must follow.
            Na so dem enta Jerry corner dey feel alright while Shoko dey look like Muchi-Muchi! Ture come ginger am say if him take 1 swagga, him go bless am. Shoko like the mugu wey him be come fall based on say mugu must fall, him no know say na setup.
            Na so dem start to dey feed am Bullet and him dey hala MORE! Before dem know, Shoko don dey Swagga. Sharp Sharp dem carry BaBa put for head dey go back Heaven, for Heaven gate BaBa collapse na him Jaguda carry am like BaBy go put for Throne.
            Medina! Medina!! Na him BaBa dey shout.Sharp Sharp,Everybody Ball out. As dem show back,na hearsay dem hearsay devil and him demons come kidnap Shoko!...
                                                                                                            To be continued…
                                                                                                            Dorti Alexis Tosan
                       

            

Who you help?

Who you help?
Tell that man wey sitdown for there,who u help? Ask that man wey dey form chairman for there,who u help? Chairman wey no fit buy me can coke,who u help?
You iron your agbada on Friday dey spread like say na wings,who u help? You iron ur suit straight dey speak many many English,who u help? In the words of rick ross “how many people u bless,that’s how u measure success”
            Election come,you dey ginger for votes meanwhile since when u dey there,who u help? U enta lecture hall dey hala for students like say u swallow trumpet meanwhile ur second name na carry-over,who u help?u come campaign dey spread money dey give ur fellow party thugs to rig election for u when the average masses no be party members,who u help?
            Na only election time u dey remember say people fit chop rice and when u dey share am dem go fight belle full before dem collect,who u help? U sitdown for president seat dey give your fellow ijaw militants contracts up and down,who u help?
            Dem give u new office U say make people help u clean am,who u help? When u dey buy,u buy for me? When u dey pop champagne,u pop for me? U get Chairman U still dey trek,guy! go do Yahoo.when I see u,u want make I dey hail like cow,loyalty don dey turn job dey loyal till u get hunchback.

            U dey school dey form Boss meanwhile ur mama and papa dey stay thatch house for sabo gari*SmH* who u help? Na to dey abuse people rights wit ur big belle,who u help?

She’S

She’S
She’s awesome, chasing her is tiresome,
She carries an aura of grandeur,
Makes me think of her like the grand duchess,
My desperate attempts seem like a single failed attempt,
Still she makes me an attempt,
And at every attempt she keeps me tempted,
Expecting me to react like a violent tempest,
Complex it might seem,
I know she’s soft like a stream,
Which makes me never run out of steam,
I promise her, together we could be a team.

                                                                                                            DORTI ALEXIS TOSAN

A dreamless thought

                                    A dreamless thought
There’s a need,
Not just for speed,
But for seed,
Cos for some, Life is like a centipede,
Moments ago I felt the greed,
Definitely not for feed,
But for something more,
More like emotions without emoticons,
More like for implementations,
That could serve as inspiration,
That this government is not built on a foundation,
Of stinking corruption,
Or manipulation…of facts,
Or casts of who theif the money,
But as I wan sleep,
I come remember say na Naija I still dey.

                                                                                                            DORTI ALEXIS TOSAN